Sunday 2 September 2018

Psalm 23 (Pidgin Version written by Dr Wilson Orhiunu)

  1. The Lord is mai sherperd
    I dey kampke
  2. He make mi sidon for where betta dey flow
    Come put me next to stream wey make mai bodi thermacool.
  3. He panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go ni; through hexpless road of righteousness for His name's sake.
  4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju pipo borku come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth.
    Your rod and staff nko?
    Na so-so comfort dem dey comfort me for belle.
  5. You don prepare Banga and starch make I chop.
    All mai enemies dey look anyaya.
    You anoint me for head wit oil.
    Mai cup na Ogunpa wey burst im banks.
  6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey ; from Lai lai to lai lai.

GOD ALMIGHTI, NA YOU BICO.




Babawilly 2000

No comments:

Post a Comment