Saturday 19 July 2014

My Pidgin English Version of Psalm 23

                                           SAM TWENTI TIRI


1.     The Lord is mai shepherd
I dey kampke

2.     He make mi sidon for where betta dey flow
Come put me next to stream wey make mai bodi
Thermacool

3.     He panel beat mai soul come spray am white,
Come dey lead me dey go ni, through express road of righteousness for His name’s sake

4.     Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419
And juju pipo borku come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth.  Your rod and staff nko?
Na so-so comfort dem dey comfort me for belle

5.     You don prepare Banga and starch make I chop
All mai enemies dey look anyaya
You anoint me for head wit oil
       Mai cup na Ogunpa wey burst im banks

6.     True true, betta life and mercy go gum mai back
Till I quench.  And man go tanda for God house sotey sotey; from Lai lai to lai lai.

       GOD ALMIGHTI, NA YOU BICO.


2000 – Babawilly.
(Dr Wilson Orhiunu)

No comments:

Post a Comment